letras.top
a b c d e f g h i j k l m n o p q r s t u v w x y z 0 1 2 3 4 5 6 7 8 9 #

letra de temporary turn permanent - sound sultan

Loading...

temporary don turn to permanent
our government come back again oh
temporary don turn to permanent
oya see them coming again oh
temporary don turn to permanent
our government come back again, eh eh
them don manya
na we dem dey point but na dem dey smoke gbana
i see road block every angle and corner
but when thief come all of dem go dey kawa
see my future leaders dem dey lean like shawa
no light, no water, you dey read and shower
nepa don change name still no power
oya on gen making noise every hour
go filling station, you go queue na yawa
line up for hours, you go sweat you go tire
one time for my people wey die for the fire
when gbese see gbese dey go full kawa
oya, black k!llers go dey meet like osama
temporary don turn to permanent
oya see them coming again oh
temporary don’ turn to permanent
our government coming again
i don manya
when black leader go dey lead like obama
dem want die there, they no even know karma
now black people blow bomb like osama
one time for the people wey die for twin tower
poor man thief, dem go burn am with tyre
rich man thief na for court you go tire
magistrate get price, every seller get buyer
the truth don die, even lawyer self na liar
working working working, one day you go retire
when you go back village you go turn to a farmer
what about the boys? all of them wan hammer
them dey carry laptop and turn to scammer
temporary don turn to permanent
oya see them coming again oh
temporary don turn to permanent
our government coming again
them don manya
na we dem dey point but na dem dey smoke gbana
i see road block every angle and corner
but when thief come all of them go dey kawa
see my future leaders, them dey lean like shawa
no light, no water, to dey read and shower
nepa don change name still no power
oya on gen making noise every hour
go filling station, you go queue na yawa
line up for hours, you go sweat you go tire
one time for my people wey die for the fire
when gbese see gbese dey go full kawa
when black leaders go dey lead like obama?
temporary don turn to permanent
oya see them coming again oh
temporary don turn to permanent
our government coming again
them don manya
when black leader go dey lead like obama?
them want die there, they no even know karma
now black people blow bomb like osama
one time for the people wey die for twin tower
poor man thief, them go burn am with tyre
rich man thief na for court you go tire
magistrate get price, every seller get buyer
truth don die, even lawyer self na liar
working working working, one day you go retire
when him go back him village he go turn to a farmer
what about the boys? all of them wan hammer
them dey carry laptop and turn to scammer, scammer, scammer
temporary don turn to permanent
oya see them coming again oh
temporary don turn to permanent
our government come back again, eh eh

letras aleatórias

MAIS ACESSADOS

Loading...