letras.top
a b c d e f g h i j k l m n o p q r s t u v w x y z 0 1 2 3 4 5 6 7 8 9 #

letra de motherland - sound sultan

Loading...

oh, ajo o dabile eh
no matter where you go, make you try come back area o
area o
na naija
ti ode ba ti le pada wale o
wale o uh o
how i wish say i fit reach you anywhere you dey eh
you dey eh
far away eh
that one no say make you dey bone area o
motherland iyo (na your area)
chinedu somebody borrow you ego
make you take carry go chicago
remember nnamdi sell him car
so you go go america
all these people wеy been dey raise you
still dey stay for facе me i face you
you promise say you no go fashi them
every other month you go dey tachi them
hillary wey you been promise to marry
still dey wait, oh boy she don tarry
when she go see you, na inside ovation
you marry oyinbo from another nation
use mago mago, get dough
now your oyinbo wife don know
next thing you know, she don go report you
wetin you know, them don deport you
how i wish say i fit reach you anywhere you dey eh
you dey eh
far away eh
that one no say make you dey bone area o
motherland iyo (na your area)
ajo o dabile eh
no matter where you go, make you try come back area o
area oh oh
na naija ah
ti ode ba ti le pada wale o
wale oh uh
you been say na 1 year
e come turn to 2 years
e don go for 7 years
but you dey serve 11 years
even when your papa die
plus the tears your mama cry
bayo for chicago, them dey miss you for okoko o
biodun for canada
your mama still dey wonder
igba wo lo to ma pada o
remember for naija, u get iyawo
ko da bi ile, ko da bi ile, ko da bi ile e, ko da bi ile, ko da bi ile e, ko da bi ile e, ajo o ma da bi ile e
how i wish say i fit reach you anywhere you dey eh
you dey eh
far away eh
that one no say make you dey bone area o
motherland iyo (na your area)
ajo o dabile eh
no matter where you go, make you try come back area o
area oh oh
na naija ah
ti ode ba ti le pada wale o
wale oh uh
you say you go call o
everybody wait tire for your call
ote o, why you go like so o
from germany to carry coco enter yankee
but then coco burst for your belle
rest in peace iyo
fly away, i come wonder if one day you fit to come iyo
your papa land iyo, i understand say you dey so far away
you gone a long long way from home, long long way from home, long long way from home, long long way eh eh
yes o
ajo o dabile eh
no matter where you go, make you try come back area o
area oh oh
na naija ah
ti ode ba ti le pada wale o
wale oh ooh oh
how i wish say i fit reach you anywhere you dey eh
you dey eh
far away eh
that one no say make you dey bone area o
motherland iyo (na your area o)

letras aleatórias

MAIS ACESSADOS

Loading...