letras.top
a b c d e f g h i j k l m n o p q r s t u v w x y z 0 1 2 3 4 5 6 7 8 9 #

letra de e come be like.. - pro obi

Loading...

intro:
april 2013

verse 1:
enter bus make we go period of jamb
me nor dey shake cas na my third
e be like chance to take blast
no be mouth guy man dey jack
when dem boys dey flex christmas
momsi go cook, clean and wash
make pikin get extra time
scatter past questions sote the pages tear
teacher throw question for cl-ss, my hand already in the air
no man be dondi (at all)
cas if you persevere (persevere)
you go be guru
my guy, you no need voodoo i swear
i stuck to my timetable
cover the whole syllables
on facebook, bb and 2go
me dey unavailable
three months before the jamb
i been dey jack post-ume self
to secure admission that year like say i be iron shelf
as baba god pilot am
the awaited day land
i pieces the exam
without bullet for my hand
na make my sleepless night for pay
sure say baba god know my pain
a week later the result date
my jamb score na 168
d-mn

hook:
e con be like god be bad guy
abi?
shebi?
e con be like god be bad guy
abi?
shebi?
e con be like god be bad guy
abi?
shebi?
e con be like god be bad guy

verse 2:
no be hin leave make jacob job esau?
na hin create amalekites dem, con tell saul ‘k!ll dem all’?
even small small pikin dem wey nor know wetin dey sup?
bros j vex use he hand scatter money for black market joint
e be like god be badt guy
when he put that tree for eden
cas if apple nor dey
mama cain for nor disobey
moses my guy too try
come make mistake fall hand
hin knack am p-ss yemi alade
e nor come go promise land
e resemble the same issue we dey face for 9ja
igbos dey vex for government, on top country matter
the government dey corrupt
some people no see food to chop
even for malay where i dey
racism be like groundnut
mehn the good die young and wicked people dey flex
bros jeremiah been vex
baba, if you dey watch like film
sure say you go hala ‘nawa’
plus man fit loose guard hin faith
make i hear from you ‘how far’
(bros j how far naw)

hook:
e con be like god be bad guy
abi?
shebi?
e con be like god be bad guy
abi?
shebi?
e con be like god be bad guy
abi?
shebi?
e con be like god be bad guy?

letras aleatórias

MAIS ACESSADOS

Loading...