letras.top
a b c d e f g h i j k l m n o p q r s t u v w x y z 0 1 2 3 4 5 6 7 8 9 #

letra de if you hear say... - oddfelix

Loading...

if you hear say i dey offline
no be say i dey depressed
no be say i take break from social media
or i no gree buy data
na my phone spoil

as village people don dey dey for city
e be like say i see thief
wey i go work
results no go show
results no dey climb stage
as these insects don chop the ladder
life hard
even small pikin go tell you
but me
i go dey do wetin i fit do
so if you no hear me release nеw poem again
no be say i quit poetry
no bе say i take the money to record go gamble
na the studios dey on strike

you see
no be every way be better way
sometimes, man gets to find him own way
even ships them get compass
and with them
you go fit do make your goal
no come pass you
as i get hand
i no go put my destiny for your own naa

so if you hear say i don die
no be say i commit suicide
na nature talk say e don do
or na person k!ll me

as i dey breathe dey go
i go dey do everything wey i fit do
to make me better
i go be my driver, my pilot, my captain
and if nothing come work
make e no be say na me shut the office door
make e be say i play my part but condition carry the cup
so if you hear say i no do again
no be say i no wan do
no be say i don give up
na the end don reach

letras aleatórias

MAIS ACESSADOS

Loading...