letras.top
a b c d e f g h i j k l m n o p q r s t u v w x y z 0 1 2 3 4 5 6 7 8 9 #

letra de grind - luckyest

Loading...

intro
lu lu luckyesto
golden star tune records

bridge (slimthug)
these days wey we turn up na girls dem dey rush us o (eh eh eh eh)
right now money be the only thing wey i wan rush (yeah yeah)
i for try to make you my wife eh but you tell me no no no
i decide connect my wi-fi, na money me i wan marry (ye)
as i dey work i dey pray make i blow like bill gate o
e don tay wey i sit down dey wait for the gate o
make my life full of grace, nor be disgrace oh
more money for the briefcase
chorus (luckyest)
that’s why i dey grind everyday (oh oh oh everyday oh)
that’s why i dey grind everyday (oh oh oh everyday oh)
that’s why i dey grind everyday (oh oh oh everyday oh)
that’s why i dey grind everyday (oh oh oh everyday oh)

verse 1 (luckyest)
i rather be fake man of god than to be church rat
i rather be army man than to be boys scout
i rather be master instead of minister
i prefer politician instead of poly teacher
nikka na tear tear na ice fish rope na im be my belt
but i must make am i even follow my cl-ssmate belt
my biggest motivation na mama okreka skirt
who go give me money to go club go order her casket
the country hard, the country hard president hard vice
who don too suffer for this country nor need advice
nobody tell me say hustle before i wise
i be dey sleep nobody wake me up before i rise
to make am again for this life, you nor need much thinking
na just your brain what you think out what you think in
life na basketball game bros, you nor must tall first
to guide your own destiny, you nor must turn fence

bridge (slimthug)
these days wey we turn up na girls dem dey rush us o (eh eh eh eh)
right now money be the only thing wey i wan rush (yeah yeah)
i for try to make you my wife eh but you tell me no no no
i decide connect my wi-fi, na money me i wan marry (ye)
as i dey work i dey pray make i blow like bill gate o
e don tay wey i sit down dey wait for the gate o
make my life full of grace, nor be disgrace oh
more money for the briefcase
chorus (luckyest)
that’s why i dey grind everyday (oh oh oh everyday oh)
that’s why i dey grind everyday (oh oh oh everyday oh)
that’s why i dey grind everyday (oh oh oh everyday oh)
that’s why i dey grind everyday (oh oh oh everyday oh)

verse 2 (luckyest)
dem nor dey tell deaf and dumb say market don scatter
before you notice, he go first you run helter skelter
time wait for no man so tell me wetin go make me dey sleep?
if we nor make money wetin we gain? how we go live?
so i dey grind, i dey grind p-ss c-ssava engine
to make mama proud i put in more energy
mama say if you tire, nobody go buy you tube
make sure say who nor get television, watch you for youtube
in a free land ogbeni no free biscuit
life na war film, life nor be comedy life nor be skit
one of my dream na to get 5 million naira shoe
that’s why i dey grind cause i nor come life come chop cashew
for the game, taking and overtaking is allowed
before i continue, wait make i burn this my loud
this my hustling na something i nor go fit take play
benz too small, god punish who say i nor go fit take plane
outro (slimthug)
make i speak in tongues
– – – – – – – – –
– – – – – – – – –
– – – – – – – – –
all the money wey i want o

letras aleatórias

MAIS ACESSADOS

Loading...