letras.top
a b c d e f g h i j k l m n o p q r s t u v w x y z 0 1 2 3 4 5 6 7 8 9 #

letra de prayer - emi  c

Loading...

oluwa e get wetin i wan yarn you
so i say make i use music, i say make i use rap
and i know say you dey hear me ye
emi c

lord, bless me with me money wey long
i won show my haters say you still dey alive
e nor go bad if dem lie down dey greet me, anytime wey i pull up in my ride
oluwa abeg run am for me. i don taya to dey eat, one square meal
for bible, you talk say na who ask dey receive, i dey on my knees lord, abeg hear me

cuz i don taya to dey suffer
poverty nor be cream, tell me why i go rub am
you are the great mathematician, so my problems dey your table, baba abeg solve am
nor be bad thing, iffa buy car, and house, for mumsi….dat woman deserve am
baba you know, my heart desires..so the rest of my prayers, make i reserve am

i won shine bright, like diamond, even if i nor be rihanna
lord bless me with money, cuz i won afford, bentley, gucci and prada
baba…abeg make my life sweet, like banga stew..and ofada
i won fly jet, cuz i don taya for taxi and okada. ehh

baba i know say you hear everything i yarn so
and i know say you go run am for me oshey

letras aleatórias

MAIS ACESSADOS

Loading...