letras.top
a b c d e f g h i j k l m n o p q r s t u v w x y z 0 1 2 3 4 5 6 7 8 9 #

letra de suspect of a kidnap case - edreez khalifa

Loading...

edreez khalifa _ suspect of a kidnap case
badman khalifa
na true story be this ooo

verse

on a beautiful monday morning naso i wake up
phone ring private no i decided to pick up
shey you no morenikeji ah said no
he drop the call then he called back again
shey you know jumoke
ah be like wuda f-ck who be this na so i hang up
2 seconds knocks on my gate na your family
they say na you be the boy freind
our pikin no sleep for house and we belive
say na your side she go dey..
for my mind i no say ah don enter deep sh-t
my heart dey beat my voice dey shake..
ah been wan deny say no be me be the boyfreind
area people don cast me say na me be the boyfreind
e don teh wey ah see ur pikin the last time ah see her self na last week friday
that was the week i came back from school for my holiday
naso ah turn suspect easy going pesin wey no dey follow anybody fight me wey be say na prospect if ah dey waka for street na respect..
the mata don cast e don gas
ah shock when ah see you for nta chanels broadcast on top radio
e no teh popo come my house
popo enter my room popo dey look for traces
popo colect my phone check my last calls and messages
na so ah enter hilux follow them go station handcuffs on my hands na so dem treat me like a criminal..
na everyday ah dey go station naso ah dey write statment…
me wey be say money no too dey my hands
300 naira go and come naso ah dey burn transport
ah no fit waka fr my street again your family dey dear me..
naso ah dey receive callz na ur relatives they call me…
shey na because ah be ur boyfreind
shey na because ah -ssure you say ah nogo cheat on you……
apart from your family na me be the second pesin wey you dey close to you suppos tell us the reason why tell us whats you going thru. may be we can help you leaving home wasn’t a good idea
you left me with all the blames leaving me with no idea
where you went to
2weeks your mama nofit sleep..
your mama dey depressed
ups and down for your search
na her pikin be dis
so she no fit rest….
your papa on the hand don spend too much
me wey be say ah be your boyfreind
wey dem labelled as suspect no fit rest…
naso ah dey post y ou on top whtsaap
facebook twitter and insta……..
with captions say you dey misssing….
after 3 weeks den you called home
say y ou dey lagos……
the mata long make i cut m short questions marks on everybodies mind whose fault…..
chargesdroped… ..
money no just carry dem go court……
..na my true story be this the matter don try shaa
my advice wey be say ah get for boys be say……
if you dey date make am dey coded…..
just you and her make everything dey loaded………
rheeeeeeeey
its your favorite boy bigtims on the mix,,

letras aleatórias

MAIS ACESSADOS

Loading...