letras.top
a b c d e f g h i j k l m n o p q r s t u v w x y z 0 1 2 3 4 5 6 7 8 9 #

letra de these tinubu times - oyiga

Loading...

oyigiyigi o
alagbawi eda

see, water full my eyes
i no go lie, achom gutter why
the government don decide say
we all got to cry
our only crime was being born inside the country
where the rich are getting richer
and the poor are only born to die

tv stations are not allowed to report a crime
them dey even tell all the newspapers them what to write
and if you cross the line
you know say them go pull up find you
because you no fit be author wey this one no authorised

you don’t know what you have till have nothing left
our hope was not renewed
we’ve gotten more depressed
the people living life 99% oppressed
the government no wan let us breath
achom pido my neck

them put farotimi for cell
so them sabi track phone
but why them no dey track all the students wey dem dey kidnap o
so how celeb go dey vex
them go gather police go dey harrass common man wey just dey find food to eat
see leaders of tomorrow fit no even see tomorrow
man i fit to kolo
to even chop, we need to borrow
too many ‘gone too soon’
too many faces for polo
but we need a hero we go take away our sorrow

and they got us all afraid
at the very thought
my people fear the government more than they fear god
and when them come to carry us wey don dey carry cross
will you stand for us
or will it still be belle first

why your mumsi dey for church
just dey pray for better days
pastor taking donations, just to make some better day
telling me jesus dey like to work with sinners all the same
you no fit preach gospel, if hunger dey (ehn, okay)

okay, belle first
reason my people get attitude
waka full surulere
n0body shine their 32
e don tey wey men dey vex
i was 16 when bubu turn president
when tinubu leaves, i might be 32
see food no dey, fuel no dey, light no dey
minimum wage wey protest, strike no pay
go olympics go represent, bike no dey
na to protest against protest na him them go dey
na to full military for street, try disobey
na to borrow till our country dey inside the gobe

suffering dey make my people think that crime is okay
hunger weaponised for chicken change, fight go dey
prices on the rise, while all my guy dem dey demise
lies upon the lies, wey dem tell the world outside

and the people batified
they don’t see that they have been blind
from abia to zamfara, suffer dey for every tribe
e no discriminate, e dey for every gate
e dey for every city and e dey for every state
e no discriminate, e dey for every gate
e dey for every city and e dey for every state

when be the last time you see 5 naira
even to chop for dream sef na wahala
poor man dey depressed, rich man sef don tire
2007 dem bring bread and akara

these tinubu times
(una go collect the bread and akara)
omo i say these tinubu times
things just hard mehn
omo i say these tinubu times
omo i say these tinubu times
when be the last time you see 5 naira
even to chop for dream sef na wahala
poor man dey depressed, rich man sef don tire
2007 dem bring bread and akara

these tinubu times
omo i say these tinubu times
these tinubu times

letras aleatórias

MAIS ACESSADOS

Loading...