letra de kangpe lyrics (feat. wesley williams) - nneka
so na so e be
na condition come make you aje like this
you say your husband, na him leave you
you say e go fit betray
so na so you dey weak
as i see you before i think say you dey kangpe
nothing fit, fit shake you, nothing fit,go fit break you
na you rake before
na you talk say you no go put man before god
see yourself as you be
na you talk say you no go put man before god oh
as you know god no go give you anything you no go fit deal with
na so dem talk,
the thing wey no fit kill you e go make you strong
e go make you strong
the thing wey no fit kill you e go make you strong
the thing wey no fit kill you e go make you strong
god no go give you anything you no go fit deal with
you talk say, you be big man
’cause you fit raise your hand,
fit beat your pikin beat e own wife
you sabi ,bible well oh
dey go church, everyday oh
notice me or i quench
look at me, how i bounce
but na you be the crook
na your kind fit open eye kill person misuse and abuse him
419,ole thief,basket mouth,ojoro
but you know how e be
when wind blow fowl nyash go open very very well oh
as you know god no go give you anything you no go fit deal with
na so dem talk,
the thing wey no fit kill you e go make you strong
e go make you strong
the thing wey no fit kill you e go make you strong
the thing wey no fit kill you e go make you strong
god no go give you anything you no go fit deal with
yo man
one question
when was the last time you ever thank the lord almighty for your life?
when was the last time you tell your wife say you love her?
when was the last time you tell your son and daughter say you love them?
as you know god no go give you anything you no go fit deal with
na so dem talk,
the thing wey no fit kill you e go make you strong
e go make you strong
the thing wey no fit kill you e go make you strong
the thing wey no fit kill you e go make you strong
god no go give you anything you no go fit deal with
and as i walk through the valley of the shadow of death
you will fear no evil for
his rod and his staff are with you
you come this far to sing your mistery
aye aye aye…
letras aleatórias
- letra de the hermit crab song - darth nater
- letra de gray area - chauncey harris
- letra de mustang dong (polish version) - brudolina studios
- letra de hey driver - zach bryan
- letra de những tháng năm tươi đẹp - đông nhi
- letra de that's cap - pinkfazo
- letra de trap shit - azzley
- letra de smr - twominuteshate
- letra de when i come home - sarah mcgowan
- letra de something to prove - polo g