
letra de who’s real - mg pablo
verse 1
how you want take know who be goat – when them wear sheep clothes…
if dem no disguise dem no go fit come close
how you want take know who be zobo – when dem be like blood…
thrive carefully bro the streets is cold
you be my blood where u dey when e red for me – you disappear like ghost when e set for me…
or better yet you stab my back wan throw me overboard…
left me drowning sinking in a pool of blood…
una dey make me wan dey doubt if love truly exist…
i hear the love in ur lips but the hate persist
when you no dey with me like this i dey miss you die…
unknowing to me for heart you dey wish me kpai…
tell me who’s real in a world where the fake is norm…
is like a bird k!llin bird for a piece of worm…
my heart dey broken and torn – i need some time to heal…
and anytime wey i hear love i dey get ptsd
chorus
i don’t know who’s real and fake – i just pray to the lord my soul to save…
i don’t wanna go to early grave – good life and the riches be the ish i crave…
tell me who’s is real now ahh eh!!! x2
verse 2
if cain fit k!ll abel for baba god blessings – imagine wetin he go do for ordinary settings…
even for church pastor no trust ushers with offerings…
n0body wan loose guard – the reason we suffering…
i dey play ps4 one cool evening for crib – when my phone ring i check na my guy kassim…
he tell me say make i fall out come lap our usual spot..
say everything dey the background – plus my favourite pot..
na once i wear my jean and shoe make i burst out from code..
as i fall out i notice some men across the road…
as a sharp guy i know say the settings no clear…
i took the next turn – make i discharge commot for there…
na so dem troway follow me – na jah save me that day…
i for no live to burst the verse wey i dey spit today…
moral of the story – survive no matter what it takes…
and cut your grasses so you go fit expose the snakes…
letras aleatórias
- letra de vem agora espírito santo - marcello brayner
- letra de meu amor de antigamente - mafalda arnauth
- letra de confusion - insite
- letra de aos farsantes com carinho - pelebrói não sei?
- letra de futuro prometido (part. sorriso maroto) - banda calypso
- letra de terra - katsbarnea
- letra de prisioneiro - andré viana
- letra de segura esse samba, ogunhê - oswaldo nunes
- letra de em mới là người yêu anh - min
- letra de entregarei meu coração - arautos do rei