
letra de abudulahi - mg pablo
verse 1
abdullahi tell me why – why you had to go…
i still remember promises you made to mama years ago
abdullahi na my guy – n-gga wey dey calm…
he be cooler than an ice mehn – this n-gga no get qualms…
abudulahi no get time – but he dey like some watches…
financially he fit red but steady e dy eye those porsches…
when he dy the dark na allah dey shine he torches…
started on the right foot – nah hе never needed clutchеs…
abdullahi na from the street – you suppose know how e dey be…
mumsy dey work for gov – most times dem find am hard to eat…
abdulahi the only son – and he get like 3 sis…
he don drop out from school – since through primary 6
abdulahi too dey smart and he loyal as he be…
so one egbon for area don dey chuck am with the pin…
don dey send am all the kpo – don dey send am all the trees…
i no believe my eyes first time i see am smoking trees…
abdulahi still too young – all of us dey like 14…
but he no dy sleep for house – dem no dey see am for like weeks..
the last time i see am he say he go try to change…
but e no dey let am do cause egbon dey give am change…
i know say you gats survive – even me i no fit feed you…
but no put your hand – for anything wey go k!ll you..
he tell me say gvdafi calm down- you too dey bother…
if i dull like you dey tell me – who go come dey feed my mother…
shortly e never too tey abdulahi don dey push…
every kind of drugs – plus e don still enter bush..
he tell me make i follow up – he say i too dey goof…
say the goal na to stack the papers till e break the roof…
my n-gga don be druggie now he dey do ice and coke…
he said i rather rich and die young than living long and broke…
as he dey clear me how e be – i swear my eyes dey soak…
cause this n-gga be like bro to me – and i love am no be joke…
i still remember when he tell say dem k!ll one of he guy…
i saw his heart gettin cold – i see the fears up in his eyes…
he say i for don craze if no be say me i dey high…
he say like 5 n-ggas must drop for him n-ggas when dem kpie…
gang life na him family – and drugs be his escape…
every night he dy stay awake – dey think about he fate…
him mumsy don notice for long – every night na she dey pray…
but evil wey he do for night must catch up by the day…
one faithful night like that – we dey our bed dey sleep…
when we heard several gunshots – bullets dey rain for our zinc…
we think say na armed robbers – so we hurry call police…
but dem no agree to come – dem put the line for busy…
i almost die from fear that night – non of us fit sleep…
the thing affect so deep – now i get ptsd
straight i go down on my kneels – pray the lord my soul to keep…
i look my mumsy for her eyes – i observe say she dey weep…
day break everywhere calm – some people gather down the street…
for my mind na wetin sup last night dem dey reason for real…
now i say make reach there – so i go know what’s up the deal…
as i dey get close – who i see na nurudeen..
na him come chuck me the pin say my n-gga man don go…
as i step further – i see my n-gga man for cold blood…
e pain me reach my bone when i see him mumsy dey groan…
plus him 3 sis dem dey cry without control
abudulahi why you go…
abudulahi why you go like this?
letras aleatórias
- letra de ticket - al kareem
- letra de intelligent spirits - methwitch
- letra de sallos (feat. kent aoki) - toluca
- letra de s.o.d. - yung nomap
- letra de sikap duniawi - isyana sarasvati
- letra de taki - chino & nacho
- letra de p.l.o. style - ergo pro
- letra de agua - sol pereyra
- letra de ten days - emma gustafson
- letra de extinction time - die krupps