letra de story time - falz
see you for leave me make i do am acappella
who wan stop my pena i go do am that panenka
oya check am
omo folarin the born sk!ller
them don know say the boy go be great okunrin meta
them say lion no dey born goat
lord knows, this one go still fulfill hin purpose
one day
but now i’m quiet in the motto
my maale don dey boil o
i know that i’m in trouble
me no just like school really
i f-ck up i know say she go discipline me
out of 54 i carry 53
my maale cry pieces
i no just like the feeling
but the young shall grow
before una know, i get double promotion sha
stop am o, no be say i no know book
na somеthing man go go through
food wey dey sweet dey slow cook
i prеfer playing boju boju
cute dribbles, word puzzles to sudoku
arithmetic my nemesis i have no clue
if e don dey wan resemble science me i no do
oga shebi i told you. i dey ball!
i’m like jayjay okocha, when i dribble men dey fall
tí n bá múra mo le replay usa 94
i get the talent and the drive, i go make am e sure
if i just try to keep am up, balance with my report card
slow down! come back
yoruba parent no too dey raise footballer
you go go university, you go read lawyer
you go be like your father, you no fit to dodge am
i con dey reason am say okay this football p
omo i go really like play am o
like professionally bro. for real
but school though, do i really have to go?
can i just dodge the p
i no dodge am o. i don dey big up
i dey feel say all my days of adolescence e don come and go
voice getting deeper, couldn’t come any quicker
that thing wey i start i go finish, i no be quitter
this thing i dey do like small hobby e don dey ginger
when i dey ss1, na there i start dey perform
shout out to my boy teddy, òun ló jé kin bèèrè gaan
we dey for dorm, we dey hear tribe’s men plenty nonsense
we listen listen till we know rap was what we wanted
how i take dey run am, walahi kò sómo béè
school boys wan play for variety show call your friends
i enter uni 16
this united kingdom e too cold for pesin pikin
new schedule no be routine
balancing no time i find my circle
this place no be my father land i for try dey careful
rap wey i dey do like play, i for up the level
enter studio proper
kò séni tó mòla
i fit go throw double 6, life na ludo run am
na then aboki call me say my talent yapa
make we start our own label, kaa le plan eh dada
baba buzz me on some bro, let’s let’s try and be business smart with this p
look. this is how them jay z started bro
they started in one room, they formed a company and…
i was like bro, which one be all this…
me i just wan make music but, no yawa, let’s go
we plan am well, we start afresh
i start dey do show here and there, money no matter first
i enter law school for abuja then, my ex girl we broke up since my 2nd year
but now i no dey find distraction
i’m just tryna make it in this game i need a platform
don’t wanna break your heart so baby i go beg your pardon
mi ò lè fún omo ní many promise, kin wá fí lè sá lor
don’t wanna take on what i know that i can’t really fathom
you no happy with my decision then cry me a gallon
i waka waka, i go tv, i go radio drop my cd
shakara the mixtape na the first time wey them go feel me
and then cool party, 1,2,3
all this time i no let lecturers to dey confuse me
2012 i was called to bar, before i turned 22
i no need to reason many before i stand for the truth
it’s the only way i know
what i saw my father do
what my mama says is right
what seems rational too
2013 i met femi soro
my guy say he see the dream, he go vibe for the culture
and all three musketeers gaan ló wà lonà
the day baba god go say him must to show him color
if we no die for road, baba nothing go k!ll us
in all versions of this story, no one where we give up
tryna convince our folks that the hustle is serious
then we hit the first million
1 million naira… eh god
they say there’s a private wedding
it’s in abuja
it’s happening this weekend
bro i’m there already
2014 i drop my first album now you know i’m a wazzup guy
same time i dey catch banter
with foladele folakemi i no plan that
talk one small tin, e cause big laughter
i talk another one, everybody scatter
sometin wey dey body since, na this one you dey chop?
i go taku for these streets
now i don dey be like jester
i dey worry for secret
but by 2015, omo stories that touch was a hit
shout out sesan salami
omo le la korí sí
when i met simi na these three people committee, wey give birth to сhemistry
are you guys dating?
what’s going on here
this this looks like there’s some romance brewing
can you guys tell us what’s…?
i start dey write my film story for jenifa’s diary
this year mo sáré gba amvca kan dání
same year, i win bet, n-ggas dey beef me
abínibí yàtò si ability
2017, i dropped 27 just before i turned 27
2018, i just wan freestyle about the state of the nation, this is nigeria
2019, they tagged me stubborn, kínni mo she, mo sáré drop moral instruction
that one no be just title, my mic e turn rifle
i hala but, i hala boj, make e no cause fight too
omó ń gbóná feli feli, e mó pe kò sénikéni
nothing wey for fit prepare me, lockdown 2020
corona virus hold the world
but that one sef no mean say bop daddy no go rock
but by the time we go return, everything don change from that wey we know before
october pulled us out to the streets, threw me the mantle
showed me if we really all came together, this what we can do
rip to those that we lost, broke me to shambles
i know say ups go still meet down for where them trample
2022 brought bad, syphilis slept on
but them go still come back
2023, was surgey, na the same ball i dey play, but i’m now 33
2024, i dropped a treat, quick 6 track and this the one that comes before the feast
red carpet fresh, k!ll em with the swag when i step out in that mad on som’
and if they ask you what’s next, say the feast is here
let them know i’m far from done!
letras aleatórias
- letra de the peace lady - barenaked ladies
- letra de oalv - rs scar
- letra de nazlı duzlu - pərviz bülbülə
- letra de don’t stop the music (raffneck ragga 12 inch remix) - 2 raff
- letra de ik kan niet ademen - mael
- letra de i am you (intro) - ynkeumalice
- letra de don't want to give it up - slowz
- letra de michtavim - מכתבים - hava alberstein - חוה אלברשטיין
- letra de thanksgiving at sea poem - pamela storch
- letra de too much - alxx